By: Esther Ayoola
Iran say dem dey hope for progress to start nuclear tuk wit US again.
Some people dey tuk say di Iran president don order make dem revive di negotiations.
Tehran dey look tori wey some countries for di area bring come and dat e don reduce tension wit Washington.
Reuters Report, say US and Iran go meet for Istanbul on Friday, US envoy Steve Witkoff and Iran foreign minister Abbas Araghchi go dey di meeting.