south west

107 Results / Page 2 of 12

Background

south west

Ondo AG Warns Obas: Palaces No Be Court Or Prison

By: Kofoworola Olayinka Ondo Attorney-General, Olukayode Ajulo, don warn traditional rulers make dem no turn palaces into courts or detention centres. Ajulo give di warning on Wednesday for Akure during workshop for traditional rulers, say dem must operate within di law. Im say Obas suppose settle disputes through mediation and refer criminal matters to police and other authorised agencies. Ajulo also urge traditional rulers to provide useful community information to […]

todayAugust 13, 2026 15

south west

Osun Senator Fadahunsi Clear Im Name After Viral Kill Video

By: Yusuf Abuh Senator representing Osun East, Francis Fadahunsi, don clear im name after one viral video wey suggest say e tell im supporters to kpai Accord Party members and dia families, say nor be wetin im mean dem edit. Fadahunsi tok dis one on Wednesday after police question am for Osun State Police Command headquarters for Osogbo over di controversial video. Di senator explain say when e use di […]

todayAugust 13, 2026 9

south west

Police Ban Amotekun, Vigilantes From Osun Election Security Operations

By: Kofoworola Olayinka Nigeria Police Force on Wednesday stop Amotekun, vigilante groups and other non-state security outfits from taking part for di Saturday Osun gorfnorship election security operations, say only authorised security pipu get role. Police spokesman CSP Ani Iniedu issue di warning on behalf of IG of Police Olatunji Disu, as di force warn political parties, candidates and supporters against engaging, arming or sending such groups. Di police say […]

todayAugust 12, 2026 21 2

south west

Osun Women Protest Beg INEC to do Free And Fair Election

By: Yusuf Abuh Osun number one lady, Titilola Adeleke, on Monday lead women protest for Osogbo against alleged arrests and violence ahead of Saturday election. Di women march from Osogbo-Ilobu Road to near Osun Police Command, carrying placards and calling for free and fair election. Dem also beg police make dem remain neutral and stop alleged arrest of dia husbands and supporters. Police stop di protesters from reaching di main […]

todayAugust 11, 2026 22

south west

Abeokuta North Stop Animals Dey Waka Anyhow

By Oluwatosin Ibrahim Abeokuta North Local Government Chairman, Olanrewaju Oyegbola-Sodipo, commission several development projects across di council and sign bye-law wey ban open grazing to improve grassroots development and strengthen governance for Ogun State. Di projects cover schools, healthcare, roads, water supply, rural electrification, sanitation and other public facilities across di 16 wards and four major communities. Ogun State Commissioner for Local Government and Chieftaincy Affairs, Ganiyu Hamzat, praise di […]

todayAugust 7, 2026 18 5

south west

Kwara CP Commission Renovated Police Station

By Oluwatosin Ibrahim Kwara State Commissioner of Police, Ojo Adekimi, commission renovated 'C' Division Police Station for Oja-Oba, Ilorin, on Thursday and urge officers make dem show more professionalism and better service because of di improved work environment. Kwara Police Command, through spokesperson Adetoun Ejire-Adeyemi, say di renovation na to provide better and more conducive place for effective policing across di area. Di inauguration attract representatives of di Emir of […]

todayAugust 7, 2026 12 4

south west

 Police Catch Woman Over N42m Visa Scam Wahala

By: Jolayemi Olajide   Ondo State Police don grab one 33-year-old woman, Adejoke Ayomide, over alleged visa scam wey make over 90 people lose N42.3 million. Police yarn say dem arrest di woman on Wednesday after victims report di matter through law firm wey represent dem and demand justice. According to police, di suspect dey pose as travel agent, promising people visa to Spain, Portugal and France but allegedly collect […]

todayAugust 6, 2026 13

south west

Atiku Blast EFCC, Say Dem Dey Chook Hand for Osun Election

By: Yusuf Abuh Presidential candidate of African Democratic Congress, Atiku Abubakar, don accuse EFCC say dem dey attack democracy after dem freeze Osun State Gornment statutory allocation account few days before Saturday gofnorship election. Atiku tok dis one on Thursday for Abuja through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, say di timing of di action no pure at all. According to am, no reason […]

todayAugust 6, 2026 18

south west

Ooni Of Ife Donate ₦100 Million, Hilux To Sunday Igboho Security Group

By: Esther Daniel Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, don donate ₦100 million and one brand-new Hilux vehicle to support Iru Ekun Security Network wey Sunday Igboho establish. Di donation happen on Tuesday during courtesy visit by Sunday Igboho and members of di security outfit to Ooni Palace for Ile-Ife. Palace announce di donation for statement wey come out on Wednesday through Director of Media and Public Affairs office. Di […]

todayAugust 5, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds