By: Yusuf Abuh
Presidential candidate of African Democratic Congress, Atiku Abubakar, don accuse EFCC say dem dey attack democracy after dem freeze Osun State Gornment statutory allocation account few days before Saturday gofnorship election.
Atiku tok dis one on Thursday for Abuja through statement wey im Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release, say di timing of di action no pure at all.
According to am, no reason fit justify why EFCC go block Osun allocation on top critical election period because e fit make people doubt whether gornment institutions dey neutral and dey follow rule of law.
Atiku come call on authorities make dem allow democracy work without intimidation, warning say any move wey fit affect free and fair election for Osun go put Nigeria democracy for serious test.