south west

107 Results / Page 3 of 12

Background

south west

Osun APC Blast Adeleke, Say Him Dey Find Excuse Before Election

By: Esther Daniel Osun State APC don fire back at Gofnor Ademola Adeleke, say all di allegation wey him make against Presido Bola Tinubu and Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, na empty talk and excuse before August 15 governorship election. For statement wey party Media Director Kola Olabisi release on Tuesday, APC tok say Adeleke claim say Tinubu and Oyetola dey persecute am politically no get head […]

todayAugust 4, 2026 17

south west

Kwara Police Shut Mouth, Say “176 People No Dey Our Record!”

By : Jolayemi Olajide Di Kwara Commissioner of Police, Ojo Adekimi, don burst di 176 kidnap gist wey dey fly everywhere, tok for Ilorin on Friday say no official security record show say terrorists carry that kind number of people for Woro and Nuku communities inside Kaiama Local Government Area. Adekimi yarn say yes, di attackers truly carry some residents comot, but anybody wey dey shout say na exactly 176 […]

todayAugust 1, 2026 15

south west

 Police Burst Kidnap Gang, Rescue Woman as One Suspect Waka Go Meet Maker

By : Jolayemi Olajide Di Enugu State Police Command don rescue one woman wey suspected kidnappers carry for Anuka Road, Okpuje inside Nsukka Local Government Area, after intelligence-led operation on Saturday end with one suspect kpai. Police spokesperson SP Daniel Ndukwe tok say di incident happen around 10:10 a.m. on July 31, when armed men comot from nearby forest storm di area and forcefully carry di woman go. Ndukwe explain […]

todayAugust 1, 2026 22

south west

Osun SSG Don Regain Freedom After Police Arrest

By: Yusuf Abuh Osun State Police Command don release Secretary to di State Government, Teslim Igbalaiye, after dem arrest am for im house for Osogbo on Wednesday. Imole Campaign Council tuk, tuk person, Pelumi Olajengbesi, announce di release and thank di Inspector General of Police and Osun Police Commissioner for responding to calls make dem free am. Police spokesperson, Abiodun Ojelabi, too confirm say Igbalaiye don regain im freedom. Igbalaiye […]

todayJuly 31, 2026 11

south west

Three kpai As Two-Storey Building Collapse For Ogun

By: Esther Daniel At least three pipo naim dem don konfam say kpai after one two-storey building collapse gbuaii for ground inside Baale Road, Ajuwon area of Ifo Local Gornment Area for Ogun State. South-West Zonal Director of NEMA, Saheed Akiode, naim use im yamchop mouth dey konfamate dis badness say dam sha rescue 12 pipo alive from di rubble. Akiode say dem go bring down di remaining part of […]

todayJuly 28, 2026 23

south west

Ondo Lawmakers Vex With Aiyedatiwa Over Impeachment Crisis

By: Esther Daniel Ondo Assembly lawmakers done accuse Govo Lucky Aiyedatiwa say im dey block dem from impeaching Speaker Olamide Oladiji over N44m chop-chop allegation. Trouble enter Assembly after 21 out of 26 lawmakers sign paper to sack di Speaker for diverting OSOPADEC budget money. Di aggrieved lawmakers give Oladiji till Sunday to resign by himself or face disgrace for House floor. Dem insist say di Govo no suppose to […]

todayJuly 28, 2026 21

OBODO NAIJA

Federal High Court Sentence Three Kidnap Suspects To Life Imprisonment Inside Abuja

By : Jolayemi Olajide Justice Salim Ibrahim inside Abuja Federal High Court sentence three suspects on Thursday to life imprisonment for dia link to di abduction of pupils and teachers for Oyo State Oriire Local Government Area, as di judge order make di sentence start count from di date dem arrest dem. Di defense lawyer beg di court for leniency before di sentencing, happening because di convicts plead guilty and […]

todayJuly 23, 2026 21

south west

Ondo Speaker Face Impeachment Threat

By: Yusuf Abuh Crisis still dey Ondo State House of Assembly as 21 lawmakers don give Speaker Olamide Oladiji till Sunday to resign or face impeachment. Di lawmakers sign impeachment notice against di Speaker over alleged financial misconduct. Out of di 26 members of di House, 21 support di move to remove Oladiji from office. As at now, di crisis never end, while lawmakers dey wait for di Speaker's next […]

todayJuly 23, 2026 23

south west

Accident Block Lagos-Ibadan Expressway As Rescue Team Clear Kara Bridge Scene

By: Esther Daniel Traffic movement don slow down for Lagos-Ibadan Expressway on Wednesday after one  accident happen around Kara Bridge area. Emergency responders begin recovery operation to remove di vehicle wey block part of di road, as motorists face delay while dem dey clear di scene. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) confirm di development through dia official X handle, say vehicles temporarily stop make recovery team fit carry out […]

todayJuly 22, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds