Sports

977 Results / Page 3 of 109

Background

Sports

La Liga Boss Say Man City Suppose Face Strong Punishment

By: Mariam Ajayi La Liga president, Javier Tebas, say Manchester City suppose face di most severe sanction available if dem breach financial regulations. Reports on Friday claim say one independent panel find City guilty of almost all of di 115 charges wey dem face for breaking Premier League rules. But Premier League never officially announce di finding or any punishment, and e never clear wetin sanction City fit face. City, […]

todaySeptember 29, 2026 12

Sports

Iwobi Go Captain Super Eagles Against Guinea Bissau

By: Kofoworola Olayinka Fulham midfielder Alex Iwobi go captain Super Eagles tonight for dia 2027 AFCON qualifier against Guinea Bissau. Regular captain Wilfred Ndidi go start di match from bench, as Iwobi lead di midfield. Iwobi, wey don make 102 appearances for Nigeria, go hope say e fit help di team build on dia 2-1 win over Madagascar for dia first qualifier Iwobi go dey lead one reorganised midfield as […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

FIFA Accuse UEFA of Misinformation Over World Cup Deal

By: Kofoworola Olayinka FIFA don accuse UEFA of running misinformation campaign as UEFA dey try force FIFA release documents about Gianni Infantino plan to sell part of World Cup business. For court case for Florida, FIFA tuk say UEFA attempt to get di documents fit also be move to influence next year FIFA presidential election. Infantino proposal for July to create commercial company wey private investors fit buy stake inside […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

Mancini Explain Why Man City Problem Nor Be Him Palava

By: Mariam Ajayi Former Man City manager Roberto Mancini wash hin hands clean from di double contract scandal, say, na di club headache and not him own business. Premier League bin hammer City with over 100 charges, including say dem hide accurate money details for players and managers during Mancini time from 2009 to 2018. When reporters corner di current Italy coach during press conference before dia game with Turkey, […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

Ilenikhena And Adams Wunjor Before Guinea-Bissau Showdown

By: Mariam Ajayi Super Eagles strikers George Ilenikhena and Akor Adams no train with di team for Uyo on Saturday as injury put dia Tuesday match against Guinea-Bissau in doubt. Di two players, wey start the 2-1 win against Madagascar on Friday wia Ilenikhena even score, na separate training dem do. Even though nobody know di full extent of di injuries wey dem pick up for the match, di team don […]

todaySeptember 28, 2026 11

Sports

Ndidi Assure Super Eagles Say Mistake No Go Happun Again

By: Mariam Ajayi Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, don give strong assurance say di team no go repeat di mistakes wey cost dem during di last World Cup qualifiers. Ndidi say di Super Eagles dey fully focused and ready to start di 2027 AFCON qualifiers with strong performance against Madagascar tonight for Uyo. E say di first game important well-well because good start go give di team di confidence and […]

todaySeptember 25, 2026 13

Sports

Chelle Tuk Say Na Our Target Against Madagascar

By: Mariam Ajayi Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo. Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Naija dey prepare for Friday’s big game. E say di team don put di result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on […]

todaySeptember 25, 2026 12

Sports

Chelle Say Three Points Na Our Target Against Madagascar

Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo. Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Nigeria dey prepare for Friday’s big game. He say di team don put the result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on Madagascar. Chelle say […]

todaySeptember 25, 2026 13

Sports

Super Eagles Fans Believe Say Nigeria Go Beat Madagascar

As 2027 AFCON qualifier dey come, some Super Eagles fans don show confidence say Nigeria go beat Madagascar. Nigeria and Madagascar go play dia opening 2027 AFCON qualifier on Friday, September 25, for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, Akwa Ibom. According to reports, both teams train separately for Uyo on Tuesday as dem continue preparations for di match. And fans tell tori pipo for Lagos on Wednesday say Naija get […]

todaySeptember 24, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds