Sports

807 Results / Page 17 of 90

Background

Sports

Odegaard Tuk up hope, Say Arsenal Still Fit Win EPL

By: Esther Ayoola Arsenal captain Martin Ødegaard say im still get hope say di Gunners fit win di Premier League title dis season, even after dem lose 2-1 to Manchester City for Etihad Stadium on Sunday. Di result reduce di gap to just three points, as Manchester City sti get one match wey dem never play yet. Ødegaard tuk to Sky Sports say Arsenal no get choice but to focus […]

todayApril 20, 2026 11

Sports

Naija Athletes Burst Outdoor Season with Records, PBs and Big Wins For US

By: Esther Ayoola Say like dis, Nigerian athletes dey show workings for outdoor season, recording wins, personal bests and even national record for sprint, jumps and throws events. Chinecherem Nnamdi win men javelin for Tom Jones Memorial for Florida wit big personal best of 84.68m wey break im own national record and push am go seventh for Africa all-time list. Kanyinsola Ajayi run 100m invitational for Auburn meet clock 9.90s […]

todayApril 20, 2026 16

Sports

Rangers Beat Enyimba 2-1, Worsen Dia Relegation Fight

By: Esther Ayoola Rangers International FC of Enugu don make Enyimba International FC relegation battle worse beating dem 2-1 for NPFL Week 35 match wey happen for Nnamdi Azikiwe Stadium, Enugu, behind closed doors. First half no get goal as both teams struggle to convert dem chances. Enyimba first score for 48th minute through Wonah Williams, but Rangers equalize for 61st minute as Chiedozie Iwundu slot am in during goalmouth […]

todayApril 20, 2026 12

Sports

Usyk Back Anthony Joshua to Beat Tyson Fury

Oleksandr Usyk don tip Anthony Joshua to beat Tyson Fury if dem finally enter ring for di long-awaited British heavyweight clash. Usyk, wey never lose fight and don face both boxers before, talk say im believe say Joshua get wetin e take to win di bout. Recently, Usyk dey train with Joshua for Spain as di former champion dey recover and prepare well after di car accident wey happen for […]

todayApril 18, 2026 19 2

Sports

Onyeka Carry Coventry Back To Premier League After 25 Years Wait

Super Eagles midfielder Frank Onyeka don helep Coventry City secure promotion enter Premier League, playing 1-1 draw with Blackburn Rovers. Say Coventry bin  just need one point for Ewood Park, and dem get am as Bobby Thomas score late equaliser for 84th minute to seal di return after 25 years. Onyeka play 62 minutes for the match, show solid performance for midfield before dem comot am put Victor Torp. The […]

todayApril 18, 2026 20

Sports

Saudi Arabia Sack Coach Renard Weeks Before 2026 World Cup

French coach Herve Renard don lose im job as Saudi Arabia national team coach, just few weeks before 2026 World Cup go start. Di French man naim by imself dey konfamate dis development for interview on Friday. Renard, wey be 57 years old, come back to coach Saudi for second time for 2024, after  carry dem go last World Cup and even beat Argentina that time. Before dis Saudi waka, […]

todayApril 17, 2026 14

Sports

D’Tigress Enter Seed 2 for Women Basketball World Cup Draw

Nigeria women's national basketball team don land Seed 2 for 2026 FIBA Women's Basketball World Cup draw wey go happen for Berlin on April 21. Say like dis, dem fit jam strong teams like USA, Germany, France or Australia wey dey Seed 1. Other Seed 2 teams na China, Belgium and Spain, while Seed 3 get Japan, Puerto Rico, Italy and South Korea. Seed 4 include Turkey, Czech Republic, Mali […]

todayApril 17, 2026 11

Sports

AFN Presido, Tonobok Open Door for Ofili Return After Switch to Turkiye Jam Rock

AFN President Tonobok Okowa say like dis Favour Ofili still get chance to represent Nigeria after World Athletics reject her move to switch nationality to Turkey. Di decision hapun for World Athletics headquarters when dem review di application wey Turkey Athletics Federation submit, and dem finally turn am down for 2026 after checking all the details. Ofili bin apply for di switch around May 2025 because she no dey satisfied […]

todayApril 17, 2026 15

Sports

Sporting Lagos Climb Back to NPFL After Late 1-0 Win Over Osun United

Sporting Lagos don secure dia return to Nigeria Premier Football League (NPFL) after dem beat Osun United 1-0 for Ileogbo, Osun State. Na Alex Leme score di only goal, while goalkeeper Clinton Lawal make serious key saves wey help dem hold di win. Dem finish top for NNL Conference B with 36 points, just one point ahead of Akwa United wey get 35 points. Na dat win make sure say […]

todayApril 17, 2026 58 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds