Sports

Must Read: Big Facts About World Cup Wey You No Know

todayAugust 28, 2026 11

Background
share close

By: Blessing Aminu

Since di 2026 World Cup just add another chapter to football history, e fit make sense to look back at some of di unbelievable moment wey make di beautiful game special.

From historic victory and strange records to players wey overcome incredible challenges, football history get plenty tori wey still dey surprise fans today, we get beta football history fact for here:

  1. First FIFA World Cup na 1930

Make we go back to 1930, when World Cup never dey popular as wey we take know am today, na Uruguay host di first-ever tournament, and na only 13 teams show face.

For di final, Uruguay face Argentina, beat dem 4–2, and just like dat, Uruguay write dia name as di first-ever World Cup champions.

 

  1. One Frenchman open di World Cup goal account

Before fans jolloficate thousands of World Cup goals, somebody gats score di first one, and dat person na Lucien Laurent of France against Mexico for 1930, Laurent fyn di back of di net for di 19th minute, enter football history forever. Na one goal wey nobody fit ever take away from am.

 

  1. Imagine say pesin carry World Cup inside suitcase

Today, World Cup trophy don get security everywhere e go. But for 1930, FIFA Presido, Jules Rimet carry di original trophy to Uruguay inside suitcase.

Just reason am say you dey travel with di most important trophy for football history inside your load.

 

  1. He lose one arm, but dat wan no stop am

Héctor Castro lose one of hin forearms when e dey 13 years, Many pipu fit reason say hin football career don finish before e even start.

But Castro continue to play, Uruguay select am for di 1930 World Cup, and di man wey dem call “El Manco” later score Uruguay fourth goal for di final. One arm no stop am from becoming World Cup champion.

 

  1. Hungary look unstoppable, until one final change everything

For 1954, Hungary look like di team wey nobody fit stop. Dem don go 30 matches without defeat, and before di same tournament, dem hammer West Germany 8–3.

Den final come, Germany turn di whole story upside down, dem come from back to sama Hungary 3–2.

Di world remember di comeback as di “Miracle of Bern.”

 

  1. Twelve goals in one match!

If una reason say modern football get too many goals, make una reson 1954. Austria and Switzerland turn dia World Cup match to complete area scatter. Austria win 7–5, wit 12 goals wey fly to di net.

Until today, no World Cup match don produce more goals.

 

  1. Pelé reach di top three times

Most players dream to win one World Cup. Pelé went further,  He won am for 1958, won again for 1962, and den lift di trophy one time again for 1970.

More dan 50 years later, nobody else don match am.

 

  1. One goal start an argument wey never really end

England face West Germany for di 1966 final. After 90 minutes, dem still no settle di matter, extra time con begin. Geoff Hurst shoot di ball hit di crossbar and bounce near di goal line. Referee award di goal, England kon dey celebrate as Germany dey protest. Hurst later finish hin hat-trick as England win 4–2, but di question wey dey dat second goal still dey live: shey the ball cross di line trutru.

 

  1. Cameroon walk into history

For 1990 World Cup, Cameroon face champions wey dey defend Argentina. On paper, Argentina suppose get di advantage. But football no dey follow paper. Cameroon shock di world, as dem beat Argentina 1–0.

Di result turn wan of di biggest World Cup upsets and later earn di name “Miracle of Milan.”

 

  1. Nigeria finally reach di big stage

For 1994, Nigeria finally make am to di World Cup. But Super Eagles no enter America just to show face, for dia first match against Bulgaria.

Nigeria come out strong , win dem 3–0, as Rashidi Yekini score first-ever World Cup goal wey Nigeria go get, hin run go net, grab am and jolificate better style.

Na moment wey Nigerians never forget.

 

  1. Italy and Germany turn 30 minutes into madness

For di 1970 World Cup, Italy and West Germany meet for one of di match wey we no fit ever forget. Normal 90 minutes no go fit settle am, so dem enter extra time, na so di goals start to dey enter.

Five goals enter for just 30 minutes of extra time before Italy finally win 4–3. Later later, football fans later give di match one ogbonge name: “Game of the Century.”

 

  1. From 13 teams to 1,000 World Cup matches

Make we jump go 2026: Tunisia and Japan turn field to another piece of history, sake of sake dia match become di 1,000th match ever played for World Cup history.

Think about am wella, from just 13 teams playing inside Uruguay in 1930 to 1,000 matches decades later. Di World Cup no just grow, e don become one of di biggest stories football don ever tell.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds