Sports

806 Results / Page 15 of 90

Background

Sports

Bayern No Go Sell Olise At All – Max Eberl

Bayern Munich don quickly shut down any gist wey dey fly about Michael Olise, as sporting director Max Eberl drop strong, message about di club stand on di French winger. Eberl tell ZDF on Saturday say di Bundesliga champions no wan hear any offer for di 23-year-old attackers, say Michael Olise no dey for sale at all, not even for one second. Di statement come as attention don dey grow […]

todayApril 26, 2026 22

Sports

Why I Comot Mbappé For Real Betis Game – Álvaro Arbeloa

Real Madrid coachie, Álvaro Arbeloa don explain why e sub striker Kylian Mbappé during dia LaLiga 1-1 draw with Real Betis on Friday. For post-match interview, Arbeloa tuk say say Mbappe feel discomfort during di game against Betis. E sti tuk say dem go see how e go be for coming days. Real Madrid go now face Espanyol for dia next match.

todayApril 25, 2026 17 1

Sports

FIFA Hold Ground Say Iran Go Sti Play Di World Cup, Cancel Italy Replacement Tuk

By: Esther Ayoola FIFA don clear matas, say dem nor get plan to replace Iran with Italy for di upcoming World Cup dis summer. According to football experts, di idea first come from US special envoy Paolo Zampolli wey suggest say Italy suppose take Iran spot for di tournament. Dis mata don cause plenty argument online because of di war between US, Israel and Iran. But FIFA president Gianni Infantino […]

todayApril 24, 2026 17 2

Sports

NFF Wan Make Osula Play For Super Eagles

Nigerian Football Federation (NFF) don enter William Osula matter, dey try convince am make e switch play for Nigeria national football team. Osula, wey dey play for Newcastle United for Premier League, fit play for Nigeria through im papa side. Di 22-year-old get Danish mama and French-Nigerian papa. Even though e don play for Denmark youth level before, e still dey show say im get strong link to Nigeria.

todayApril 23, 2026 21

Sports

Arsenal Fit Go Six Points Ahead of Mancity – Paul Merson

Former England midfielder, Paul Merson, don talk say Arsenal fit go six points clear of Manchester City for di Premier League title race. Like dis like dis, Man City dey top table after dem beat Burnley 1-0 on Wednesday night. Pep Guardiola side just dey ahead of Arsenal on goals scored, as both teams get same points and same goal difference. Merson talk say Arsenal fit collect back di top […]

todayApril 23, 2026 19

Sports

Haaland Early Goal Carry Man City Go Top of EPL Table

Erling Haaland score as Manchester City beat Burnley 1-0 for Turf Moor, take jump pass Arsenal for top of  Premier League table. Di win also confirm say Burnley don go back to Championship. Even though City try anoda 28 shots, dem no add another goal as Haaland and Cherki even hit post. Arsenal fit still return top if dem beat Newcastle, but for now na City dey lead di table.

todayApril 23, 2026 16 25

Sports

Chelsea, Super Eagles Hail Mikel Obi for 39th Birthday

By: Esther Ayoola Say nor bi small Jolitainment for John Mikel Obi as e mark im 39th birthday on Tuesday, say na both Chelsea and Naija national football team join honour am with sweet messages. Chelsea or dia own post birthday shout-out for dia official social media, while Super Eagles also drop tribute to di former captain untop green jersey. Mikel, wey mama born for Jos on April 22, 1987, […]

todayApril 22, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds