Sports

977 Results / Page 19 of 109

Background

Sports

Enzo Fernandez Fit Leave Chelsea? former Star Morris Tell Club Make Dem Sell Am

By: Esther Daniel Former Chelsea player, Jody Morris, don advise Chelsea make dem sell midfielder Enzo Fernandez if di player still dey push to leave di club for dis summer transfer window. According to Morris, if Fernandez no get mind to stay for Stamford Bridge, e better make Chelsea cash out now instead of waiting. Di Argentina international wey join Chelsea from Benfica for 2023 don reportedly show interest to […]

todayJuly 27, 2026 22 2

Sports

Police Grab Suspect Wey Tif Super Falcons Players Money For Morocco Hotel

By: Esther Daniel Police don arrest one suspect wey confess say e tif cash from some Super Falcons players for Marriott Hotel, Casablanca, Morocco, few days before Nigeria first match for 2026 Women's Africa Cup of Nations. Di suspect go return all di money wey e thief, while criminal case don ready to start against am. Midfielder Esther Okoronkwo tok say she, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, defender Michelle Alozie and captain […]

todayJuly 27, 2026 23 3

Sports

Algeria Beat Senegal 2-0 for WAFCON Opener

By: Esther Daniel Algeria don start dia 2026 Women's Africa Cup of Nations campaign with sweet 2-0 victory over Senegal on Sunday for Rabat. Captain Marine Dafeur naim first score from penalty before halftime, while Melissa Bethi seal di win for 88th minute after Senegal goalkeeper Khady Faye make costly mistake. Senegal try put pressure for di beginning of di match, but dem no fit convert dia chances as Algeria […]

todayJuly 27, 2026 12

Sports

Joshua Promoter Tok Say Fury Fight Go Happen

By: Yusuf Abuh Promoter of Anthony Joshua, Eddie Hearn, don dismiss wetin Tyson Fury tok say dia long-awaited fight fit no hapun again. Fury go face Poland boxer Mariusz Wach for Thailand on Friday, while Joshua go enter ring against Albania boxer Kristian Prenga for Saudi Arabia on Saturday, and both fights na preparation before dia expected big showdown. Di two British heavyweight boxers never fight each other before, even […]

todayJuly 24, 2026 21

Sports

Mali, Niger, Burkina Faso Want Host 2032 AFCON Together

By: Yusuf Abuh Mali, Niger and Burkina Faso don begin plan to host di 2032 Africa Cup of Nations (AFCON) together, as di three military-led countries join body under di Alliance of Sahel States. Malian Football Federation tok say dia officials meet Confederation of African Football (CAF) President Patrice Motsepe for New York on Saturday to discuss di joint bid. According to di federation, di meeting na important step to […]

todayJuly 23, 2026 17

Sports

CAF Hail Africa Teams for Historic World Cup Performance

By: Esther Daniel CAF President, Dr Patrice Motsepe, don praise di performance of African national teams for FIFA World Cup 2026, say di continent achieve historic success and football for Africa dey grow well. For statement wey CAF release on Wednesday, Motsepe say out of di 10 African countries wey play for di expanded 48-team tournament, nine qualify from di group stage enter Round of 32. According to am, dis […]

todayJuly 22, 2026 27

Sports

Arsenal Sign Real Madrid Captain Misa Rodriguez On Free Transfer

By: Esther Daniel Arsenal Women don complete di signing of Real Madrid captain, Misa Rodriguez. Di 27-year-old goalkeeper join di English club after im contract with Real Madrid expire. Rodriguez go add more strength to Arsenal goalkeeping department wey already get Daphne Van Domselaar, Anneke Borbe and Isabella Damm. Di Spanish goalkeeper make 215 appearances for Real Madrid and also don represent Spain 24 times. She become Arsenal seventh signing […]

todayJuly 22, 2026 19

Sports

Ola Aina Say Arsenal No Be Option for Am

By: Esther Daniel Super Eagles defender Ola Aina don laugh brush aside talk say e fit join Arsenal, as one Nigerian fan ask am di question during Wimbledon. Aina wey dey 29 years, reply with smile say, "I too old for Arsenal." Di defender don spend three seasons with Nottingham Forest after e join di club from Torino for 2023, and before dat e also play for Fulham. Even though […]

todayJuly 22, 2026 20

Sports

Messi Finally Talk After Spain Beat Argentina for World Cup Final

By: Esther Daniel Argentina captain Lionel Messi don finally tuk after Argentina lose 1-0 to Spain for di 2026 FIFA World Cup final wey happen for United States on Sunday. Messi post im reaction online on Monday, after e no talk to journalists immediately after di match. Di Inter Miami star admit say di defeat pain well-well and e go hard to forget, but e still praise im teammates for di […]

todayJuly 21, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds