By: Mariam Ajayi
Manchester United don make initial £60 million offer for Brighton midfielder Carlos Baleba as dem continue to strengthen dia midfield ahead of di new season.
United bin try sign di Cameroon international last summer but Brighton valuation wey pass £100 million make di deal no happen.
But Baleba price don drop significantly and after United fail to sign Matheus Fernandes, dem don return for di midfielder again.
Brighton valuation still dey above United offer, but both clubs dey continue talks as Man United push to land Baleba.