By: Esther Daniel
UEFA don threaten FIFA Presido Gianni Infantino with legal action and warn am say make nobody destroy any document about di controversial plan to sell shares in FIFA competitions.
Di matter burst after reports show say FIFA wan sell part ownership of tournaments like men and women World Cup plus Club World Cup under one plan wey dem call FIFA Forward Enterprise.
UEFA, together wit CONCACAF and AFC, reject di idea and warn say dem no go support any move wey fit affect how football competitions dey run.