Sports

673 Results / Page 33 of 75

Background

Sports

Cristiano Ronaldo Vow Say E Go Win More Trophies, Chase 1,000 Goals

By: Rilwan Agbomeji Football superstar Cristiano Ronaldo don vow for ground, say e wan win more trophies and reach 1,000 career goals before im retire finally. Ronaldo yarn dis one for Globe Soccer Awards wey hold for Dubai on Sunday, say e still get passion to play no matter where e dey,Europe or Middle East. E add say e go reach the 1,000 goals target if wunjury no worry am.

todayDecember 29, 2025 30

Sports

Lagos Boxing Hall Of Fame Train Boxing Talent

By: Esther Ayoola Lagos boxing hall of fame don show workings again, say dem go use monthly tournament, take build young fighters for world stage. For di 2025 edition, Faruk Ajibuwon, African youth games gold medalist, grab best boxer of di year and pocket ₦1 million, tie governor belt for wast, after im beat Osun’ state Malik Onifade for men’s 50kg. U sabi say, LBHF don produce big names like […]

todayDecember 29, 2025 11

Sports

Nwabali No Shakement For Super Eagles As Dem Qualify For Afcon Round Of 16

By: Esther Ayoola Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali say e no dey worry about say Nigeria never keep clean sheet for di 2025 AFCON, as e dismiss talk say di defence get problem. Nigeria don concede three goals for two Group C matches but still score five, beating Tanzania 2–1 and Tunisia 3–2 to qualify for round of 16. Even though people complain say di team dey concede, di super […]

todayDecember 29, 2025 11

Sports

FIFA Reject NFF Appeal, End Super Eagles 2026 World Cup Dream

By: Rilwan Agbomeji Nigeria hope to qualify for 2026 FIFA World Cup don end afta FIFA reject di appeal wey NFF submit against DR Congo. Super Eagles bin lose di intercontinental playoff final for Rabat, Morocco on November 16, afta match end 1–1 and DR Congo win penalty 4–3. Nigeria argue say some DR Congo players no suppose play, but FIFA say all di players correct and no rule break […]

todayDecember 26, 2025 32

Sports

Chelle Drop Yarns Ahead Of Tunisia Clash

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles head coachie Eric Chelle don giv expo say e fit change tactics for Saturday Group C match against Tunisia. Di match go happen for Fes, Morocco as both teams dey chase back-to-back wins. You sabi say Super Eagles beat Tanzania 2-1, while Tunisia beat Uganda 3-1. Fans dey expect serious football as Nigeria and Tunisia ready clash for weekend.

todayDecember 26, 2025 9

Sports

CAF Arrange Malian Referee For Super Eagles Vs Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Say confederation of African football, don appoint Malian referee Boubou Traore say make im take di centre stage as Super Eagles of Nigeria go face Carthage Eagles of Tunisia for dia Group C match for 2025 AFCON wey go happen for Complexe Sportif de Fès. Traore na well-respected referee for Africa, while Senegal own Issa Sy go handle VAR. Super Eagles don start dia campaign well with […]

todayDecember 26, 2025 78

Sports

Super Eagles, Tunisia Set For Hot AFCON Fez Showdown

By: Rilwan Agbomeji Say tickets for Nigeria Super Eagles group match against Tunisia for fez stadium dis Saturday, say don sold out, for tournament wey pipo dey complain of low attendance. Nigeria beat Tanzania 2–1 for dia first match, while Tunisia take Uganda 3–1, so both teams get three points each. Winner for dis fez clash go almost secure qualification enter round of 16.  

todayDecember 26, 2025 18

Sports

Super Eagles Train For Tunisia Inside House

By: Rilwan Agbomeji Unto to marras, say di Super Eagles go run small training behind closed door today, Thursday, with Christmas rice and chicken for di AFCON match against Tunisia. Team media officer, Promise Efoghe, yarn na troway di update say following di coachie, Eric Chelle order . Coach wan keep tactics and lineup secret as dem ready for AFCON 2025 clash.  

todayDecember 25, 2025 15 2

Sports

Valencia Eye Emmanuel Dennis As Dem Dey Find Striker

By: Rilwan Agbomeji E be like say Spanish club, Valencia dey plan move to sign free agent Emmanuel Dennis. Dennis wey Nottingham Forest release for summer don dey attract interest from different clubs for Europe and Asia. According to reports, Valencia don put di Super Eagles forward for dia watchlist as dem dey find better striker. Valencia season no dey sweet at all as dem dey sit for 17th position […]

todayDecember 25, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app