Sports

673 Results / Page 34 of 75

Background

Sports

Super Falcons Star Esther Okoronkwo Share ₦200k Cash Gifts

By: Rilwan Agbomeji Super Falcons Striker Esther Okoronkwo don spoil area with Christmas gift, show love, surprise people for Abia State with cash gifts. Na for one video wey she post for Instagram on Christmas Day, na a aproko pipo go gbab say,  Esther dey share money give drivers, traders, shoppers and people wey dey road for Umuahia. Di Abia-born footballer, wey dey play for AFC Toronto for Canada, say […]

todayDecember 25, 2025 19

Sports

Coach Gamondi Say Tanzania Sabi Ball Pass Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coach Miguel Gamondi talk say e still dey happy small with how im team play, even though dem lose 2–1 to Nigeria for AFCON match on Tuesday. Na Nigeria score first through Semi Ajayi, before Charles M’mombwa equalise for Tanzania early second half. But celebration no last as Ademola Lookman quickly score winner give super eagles, while Tanzania still dey find dia first AFCON win.   […]

todayDecember 25, 2025 31

Sports

AFCON 2025 – Simon Sure Say Super Eagles Go Beat Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Moses Simon don talk say Naija go fight hard make dem collect full points against Tunisia for AFCON 2025. Di match go happen Saturday for Complexe de Fès for Morocco, as both teams dey eye anoda win. Simon say team dey confident and ready to overcome Tunisia, wey dem dey call Carthage Eagles. Nigeria and Tunisia don start di tournament with win, and dis […]

todayDecember 24, 2025 9

Sports

Super Eagles Coachie Chelle Tell Players To Do Beta

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles coach, Eric Chelle, don change am for im players tell dem say, make dem nor repeat that anyhow character wey dem do against Tanzania with anybody E say, even though super eagles win 2 goals to 1 on Tuesday, say super eagles suppose do beta But sha im go manage di three point, but moving faward, na only beta football e want to dey see […]

todayDecember 24, 2025 9

Sports

AFCON – Naija Super Eagles Show Workings Beat Tanzania 2-1

By: Rilwan Agbomeji Nigeria don start dia AFCON 2025 campaign well, as Super Eagles beat Tanzania 2-1 for Stade de Fez, as Semi Ajayi and Ademola Lookman score. Tanzania try fight back, even score one, but Lookman quick reply make Nigeria take all three points. With dis win, Nigeria dey top Group C join with Tunisia wey beat Uganda 3-1 while Tanzania go need beta result next match.    

todayDecember 24, 2025 14

Sports

Troost-Ekong Collect National Honour Certificate From Presido Tinubu

By: Rilwan Agbomeji  Retired Super Eagles captain William Troost-Ekong don receive national honour certificate from Presido, Bola Ahmad Tinubu on Monday. Troost-Ekong announce di receipt for X on Tuesday, say e dey proud for im and im family. Di award na Member of di Order of di Federal Republic (MFR), wey Tinubu giv am for official ceremony. E thank President Tinubu for di honour, call am big recognition for im […]

todayDecember 23, 2025 12

Sports

EPL: Liverpool’s Isak Do Surgery For Leg, Say Im Go Dey Out Months

By: Esther Ayoola Liverpool don share update dat dem don do surgery for Swedish striker Alexander Isak afta im wunjor im leg for Saturday match against Tottenham. According to report on Tuesday, say di Sweden striker leg dey broken, fibula scatter small, but surgery go well. Club never yarn how long e go take recover, but dem talk say Isak go dey sideline for at least  few months.

todayDecember 23, 2025 9

Sports

Tanzania Eyes First Ever Afcon Win Say Na Nigeria Dem Wan Take Start

By: Esther Ayoola Tanzania cochie, Miguel Gamondi,  ni bring mata dis morning on say if  dem fit finally get dia first victory when dem play Nigeria for 2025 AFCON for Morocco on Tuesday, e go belike say na world cup dem win. Di taifa stars don play three AFCON tournaments—1980, 2019, and 2023—and dem never win any of dia nine matches, so dis group C opener go be dia 10th […]

todayDecember 23, 2025 6

Sports

Zambia Carry Last-Minute Draw Against Mali For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji AFCON 2025 Group B take enter stage on Monday Afternoon as Zambia and Mali take play 1-1 draw. Mali start sharp from kickoff and create plenty chances, but El Bilal Touré miss big penalty for 41st minute. For 60th minute, Mali finally score when Lassine Sinayoko finish clean from corner move. Zambia no gree loss, Patson Daka later score one mad equalizer wey carry di game enter […]

todayDecember 22, 2025 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app