Sports

Mo’ Salah Celebrate Birthday For World Cup

todayJune 16, 2026 5

Background
share close

Unto World cup updates, Belgium and Egypt play 1-1 draw for dia World Cup opener on Monday, as Belgian second-half equaliser spoil Mohamed Salah birthday wey turn 34.

Emam Ashour naim score first for Egypt early for first half inside Seattle.

Romelu Lukaku enter as substitute, naim con force Egypt player Mohamed Hany to score own goal wey level di match.

With di result, Egypt still dey find dia first World Cup win, as dem go face Iran and New Zealand next for Group G.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds