Sports

980 Results / Page 44 of 109

Background

Sports

Adesanya Chop Fourth Straight Loss For Seattle UFC Fight Night

Former middleweight champ Israel Adesanya don chop im fourth straight loss as Joe Pyfer knock am out for UFC Fight Night on Saturday night. Pyfer win di fight by TKO for second round, inside Climate Pledge Arena for Seattle, USA. Adesanya start di fight well, use some kind of sharp movement and korect punches control di first round. But later, Pyfer chest di pressure, change di game with heavy blows […]

todayMarch 29, 2026 28

Sports

FIFA Drop New Rules For 2026 World Cup

By: Esther Ayoola FIFA don announce new rules wey dem go use for 2026 World Cup for USA, Mexico, and Canada. Now, any player wey dem dey substitute get only 10 seconds to waka comot, or im team go play wit 10 players for one minute. Throw-ins and goal kicks get 5-second timer, and if dem delay, opposition go carry ball. Any player wey dey get medical attention must waka […]

todayMarch 27, 2026 25

Sports

D’Tigress To Jam Indiana Fever For Big USA Preseason Game May 2

By: Esther Ayoola Naija women basketball team, D’Tigress, don add one big game for dia USA tour as dem go play against Indiana Fever for preseason. Di game go hapun for May 2, 2026, for Gainbridge Fieldhouse, Indianapolis, as dem dey prepare for 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup. Team Naija announce di new fixture for X, say dem don already get game for San Diego and Kansas City before […]

todayMarch 27, 2026 28

Sports

Senegal To Parade AFCON Trophy For Paris

By: Esther Ayoola Say like dis, Senegal dey plan show dia Africa Cup of Nations trophy before dia game wey dem go play against Peru for Paris on Saturday. Dis na according to head of Senegal Football Federation, Papa Amadou Diop. Nor be amebo say, Di Teranga lions win dia second Afcon trophy on 18 January afta dem beat Morocco 1-0 for Morocco, but di win, issue full am based […]

todayMarch 27, 2026 22

Sports

Wunjury Drop Bassey Out Of Super Eagles Friendly Matches

Calvin Bassey don drop out of Super Eagles friendly matches against Iran and Jordan after injury stop am ahead of games wey go start dis weekend. According to report, di Fulham defender get back injury after im strong performance for AFCON 2025 for Morocco in January. Team officials confirm say all 22 invited players don arrive camp, as dem start first training on Wednesday evening. Meanwhile, captain Wilfred Ndidi arrival […]

todayMarch 26, 2026 49

Sports

Super Eagles World Cup Dream Finally End As Playoffs Start Today

Nigeria Super Eagles don finally miss out from di 2026 World Cup, say world cup playoff dey start today. Now teams dey prepare for play-off wey go start for Mexico today, where six countries dey fight for two spots. U sabi say DR Congo beat Nigeria 4-3 on penalties last November for African play-off final for Morocco. Even with dat loss, NFF still dey try appeal because dem claim DR […]

todayMarch 26, 2026 31

Sports

Jannik Sinner Break Record, Win 28 Sets Straight For Miami Open

Jannik Sinner don make history, wining again for Miami Open, beating Alex Michelsen 7-5 7-6 (7-4). Di Italian, wey be world number two, like dis now don win 28 sets straight for ATP Masters 1,000 events. For di second set, Sinner nearly loss, im dey 5-2 behind before im comeback win for tie-break. Im sti win di last two Masters 1,000 tournaments, Indian Wells and Paris, not losing any set.

todayMarch 25, 2026 31 2

Sports

15 Super Eagles Players Land For Antalya Camp

Fifteen players don land for Super Eagles camp for Antalya, Turkey, as dem dey prepare for international friendly match wey dem go play against Iran and Jordan dis month. According to Super Eagles tuk, tuk person Promise Efoghe, say na 15 players don report  for camp, but forward Samuel Chukwueze and goalkeeper Maduka Okoye go join later. Coaches and officials don reach camp to arrange everything before players land. Assistant […]

todayMarch 25, 2026 24 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds