Former heavyweight champ Anthony Joshua don snub Tyson Fury fight offer straight after Saturday night bout for Tottenham Hotspur Stadium.
Fury breeze pass Arslanbek Makhmudov for one dry, one-sided fight wey no even spark di crowd.
As Joshua dey ringside dey watch, na so fury call am out make e enter ring.
But Joshua no show face for ring, e ignore di call, and some fans begin boo am.
Later, Joshua reply say Tyson dey chase cloutand dat e never fear to enter ring with am.
E sti add say e don knock am out when dem be kids, and after wetin e see tonight say e go beat am again.