Sports

980 Results / Page 48 of 109

Background

Sports

3SC Shine For Ibadan, Beat Rivers United 2-1

By: Esther Ayoola Shooting Stars Sports Club (3SC) for Ibadan beat Rivers United FC 2-1 for dia rescheduled NPFL Match Day 24 game wey hapun for Lekan Salami Stadium on Thursday. Na dia 13th win dis season, wit 5 draws and 11 losses, now dem dey  6th position for di league table. For home matches, 3SC dey strong, with 11 wins, 2 draws, and 1 loss, but dia away form […]

todayMarch 13, 2026 29

Sports

Moffi Score, Sanusi Give Assist As FC Porto Beat Stuttgart 2-1

By: Esther Ayoola Terem Moffi score one goal and Zaidu Sanusi give assist as FC Porto beat Stuttgart 2-1 away for dia UEFA Europa League Round of 16 first leg game for Germany on Thursday. Moffi start di game but comot for 59th minute, while Sanusi play full 90 minutes. Moffi open scoring for di 21st minute, and later Sanusi set up Rodrigo Mora to make am 2-0. Stuttgart reduce […]

todayMarch 13, 2026 22

Sports

D’Tigress Lose 77-60 To South Korea For FIBA World Cup Qualifier

By: Esther Ayoola Naija’s D’Tigress don lose to South Korea 77-60 for dia second game for di qualifying tournament for di 2026 FIBA Women’s World Cup. Di last time D’Tigress lose na for quarter-final against United States for di Paris 2024 Olympics. Dem enter South Korea game on Thursday afta dem knack Colombia for dia first match for Wednesday. For di first quarter, South Korea  lead 20-16, and even though […]

todayMarch 13, 2026 29

Sports

Quadri Aruna Remain Winless As Félix Lebrun Beat Am 3–0 For WTT

Nigeria table tennis star, Quadri Aruna, never fit win any WTT match 2026, again don go lose 3–0 to France player Félix Lebrun for WTT Champions Chongqing on Tuesday. Lebrun, wey dey 19 years old, hammer Aruna 11–5, 11–6, 11–3 for round of 32. Dis one make Aruna still dey wait for im first WTT win since September 2025, wen e beat China player Huang Youzheng. Na dia fourth time […]

todayMarch 11, 2026 44 1

Sports

Galatasaray Beat Liverpool 1 kondo For UCL

Victor Osimhen give correct assist as Galatasaray knack Liverpool 1-0 for RAMs Park on Tuesday night champions league. Im deliver beta pass give Gabonish,  Mario Lemina, to score di only goal for di seventh minute. Dis na Osimhen third assist for dis UEFA Champions League season, with seven goals.

todayMarch 11, 2026 40

Sports

Naija Football Legend, Chief Festus Onigbinde, Kpai At Age 88

By: Esther Ayoola Say Naija don lose one of dia big football oga, Chief Festus Onigbinde, wey be di first Nigerian  indigenous coachie for  di Super Eagles. Di family announced im passing in a statement signed by im Grand pikin, Bolade Adesuyi on Monday. According to report, di senior man kpai on Monday, and e bin dey 88 years old. Di family wey konfamate im passing, say Festus na Korrect […]

todayMarch 10, 2026 32

Sports

FA Cup Quarter-Final, Man City To Face Liverpool, Port Vale Go Play Chelsea

By: Esther Ayoola England don finish quarter finals draws for FA cup, dat Manchester City go jam Liverpool for FA Cup quarter-finals. According to BBC Sport, Port Vale, wey dey League One, go travel go Chelsea afta dem comot Sunderland. Arsenal go waka go Southampton, wey dey Championship, while Leeds go face West Ham. All di matches, dem go play am for April.

todayMarch 10, 2026 28

Sports

NFF To Fine Clubs Wey Go Dodge President Federal Cup

By: Esther Ayoola Di Naija Football Federation (NFF) don declare say any club wey no show for dis year President Federation Cup State preliminaries go pay N500,000 fine. NFF’s Director of Competitions, Ruth David, ni dey put dis one for statement on Monday. Say, State preliminaries go start on Sunday, 22nd March, come run till 26th April. Final match for State level go hapun either Saturday 25th April or Sunday […]

todayMarch 10, 2026 23

Sports

How Ref Take Serve 23 Players Red Card For Brazilian Finals

By: Esther Ayoola Wahala dem say nor dey finish, say nor be small fight burst for Brazil during Campeonato Mineiro final between Cruzeiro and Atlético Mineiro after Cruzeiro manage win di match 1–0. Di trouble start for deep stoppage time when Atlético goalkeeper Everson rugby-tackle Cruzeiro midfielder Christian after dem clash as di keeper drop di ball. Everson even kneel for Christian face and shout for am, and na dat […]

todayMarch 9, 2026 55

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds