Sports

808 Results / Page 47 of 90

Background

Sports

Lazio Coach Sarri Do Small Heart Operation

By: Esther Ayoola Lazio coach Maurizio Sarri don undergo small heart operation afta doctors find say im get atrial fibrillation wey dey affect heart rhythm. Di Serie A club talk say di operation be routine and dem expect di 66-year-old manager to resume work in few days. For statement wey dem post for X, Lazio confirm say Sarri do transcatheter ablation for Policlinico Tor Vergata hospital.

todayDecember 31, 2025 13

Sports

Super Eagles Sweep AFCON Group Stage

By: Esther Ayoola Super Eagles of Nigeria don finish AFCON Group C with 100% win record, beating Uganda 3-1 to finish top of di group. Before dis game, Nigeria already beat Tanzania 2-1 and beat Tunisia 3-2, so dem collect 9 points finish di group stage. For di final group match, Super Eagles open scoring 28th minute through Paul Onuachu, and Raphael Onyedika add two quick goals for second half […]

todayDecember 31, 2025 16

Sports

Aruna Quadri Finish 2025 As Africa No. 1 Table Tennis Player, 28th For World

By: Esther Ayoola Nigeria table tennis star, Aruna Quadri, don finish 2025 as Africa number one, International Table Tennis Federation ranking show on Tuesday. Quadri wey don hold Africa top for most part of the year, end the season 28th for world with 1,065 points, the only African wey pass 1,000 points for men ranking. Egypt player Omar Assar follow, e dey 32nd for world with 965 points according to […]

todayDecember 31, 2025 20

Sports

Liverpool Part Ways With Coach Aaron Briggs

By: Rilwan Agbomeji Liverpool Football Club don  share surprise update, dat Aaron Briggs, wey join di club as individual development coach for July 2024, go leave im role with immediate effect. Di club post for dia official website on Tuesday dat, Briggs dey important part of Arne Slot backroom staff and e help Liverpool win last season Premier League. Dem nor  really give full gist on why im dey comot, […]

todayDecember 30, 2025 22

Sports

FRSC Investigate Joshua Road Crash

By: Esther Ayoola Untop di updates of di accident wey involve Nigerian boxing star Anthony Joshua, say di federal road safety don dey touchlight di mata unto wetin really cause di accident Di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn on Tuesday say dem dey wait full technical report to know di exact reason for di crash. Untop yanings for TV sitdon tuk, FRSC spokesperson Olusegun Ogungbemide tuk say preliminary assessment […]

todayDecember 30, 2025 32

Sports

British Deputy Head Visit Anthony Joshua For Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Di Deputy Head of Mission for British High Commission, Simon Field, don visit world heavyweight boxing champion Anthony Joshua for hospital after di deadly road accident for Lagos–Ibadan Expressway. According to statement from Special Adviser on Information and Strategy to Ogun State Governor, Kayode Akinmade, dis one hapun on tuesday. Say, Field also meet Ogun State Governor Dapo Abiodun and Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu to discuss […]

todayDecember 30, 2025 32

Sports

NBF Presido Greet Anthony Joshua Over Fatal Crash

By; Esther Ayoola Presido of Nigeria Boxing Federation and Minister of Finance, Wale Edun, don wire SMS condolence to Anthony Joshua and families of two people wey kpai for di road accident for Lagos-Ibadan Expressway, yesterday, say sorry. Edun call Anthony Joshua national treasure and say boxing community dey pray for im quick recovery and for God to comfort di bereaved families. You go remember say, di accident happen Monday […]

todayDecember 30, 2025 30

Sports

Atletico Legend Enrique Collar Kpai For Age 91

By: Esther Ayoola Atletico Madrid don announce say club legend Enrique Collar don die for age 91. Collar be wey be correct left winger, score 105 goals for 470 matches and captain Atletico for 10 years during the 1960s. E help lead di club win league title and three Copa del Rey trophies, including one win against Real Madrid for Bernabeu in 1960.

todayDecember 30, 2025 18

Sports

Super Eagles Coachie Release Expo Ahead Uganda Tie

By: Esther Ayoola Super Eagles head coach, Eric Chelle, share expo, say he fit rotate players for Nigeria Group C match against Uganda for AFCON. Chelle tuk dis one on Monday for him pre-match press conference for Fez Stadium, say many players deserve chance and e no wan depend on only one fixed starting eleven. He add say for football tournament, na full squad involvement ni be di koko, not […]

todayDecember 30, 2025 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds