Sports

980 Results / Page 50 of 109

Background

Sports

Bayern Munich Eye Victor Osimhen To Replace Harry Kane

Bayern Munich don resume interest for Galatasaray striker Victor Osimhen, say dem need am if Harry Kane waka. Coach Vincent Kompany dey consider am because Kane dey attract Barcelona and other Premier League clubs. Kane don score 130 goals for 133 matches even though im never dey for Bayern for long. Since no offer don land yet, Bayern feel say Osimhen na di best replacement, if Kane move.

todayMarch 4, 2026 43

Sports

Atletico Madrid Stand Gidigba, Knock Barcelona Comot 4-3 For Copa Del Rey

Barcelona try dia best chase Atletico Madrid for Copa del Rey semi-final but God pass dem, losing 4-3 on aggregate. Marc Bernal score two goals and Raphinha score penalty, and still dem nor make am to di finals. Atletico hold strong, and now, go meet Real Sociedad or Athletic Club for di final. First leg, Barcelona don already lose 4-0, so e hard dem to do complete come back.

todayMarch 4, 2026 34

Sports

Ronaldo Japa Go Madrid As Middle East Wahala blow Hot

Al-Nassr captain and forward, Cristiano Ronaldo,  comot Saudi Arabia go Madrid, Spain, as tension for Middle East dey rise after US and Israel launch strike for Iran. According to reports on Tuesday, di 41-year-old football star fly comot Riyadh late for night inside im £61 million Bombardier Global Express 6500 private jet. Di move happen after serious attack for di region, as two drones hit US embassy for Riyadh overnight. […]

todayMarch 3, 2026 29

Sports

Scholes Want Ancelotti For Man United

Mancester United Legend, Paul Scholes don identify perfect manager, say im want Manchester United to sign Carlo Ancelotti. Since Michael Carrick take over from Ruben Amorim, e never lose match and don carry di team reach third position for Premier League table, pass Aston Villa, Liverpool and Chelsea. For Tv siddon talk, Scholes say e still wan see how Carrick go handle serious wahala and pressure before e fully support […]

todayMarch 3, 2026 32

Sports

Galatasaray Rest Victor Osimhen For Turkish Cup Match

Say Galatasaray nor go use Victor Osimhen for tonight Turkish Cup match against Alanyaspor, dem say e dey on “active rest.” Other players like Uğurcan Çakır, Davinson Sanchez, Mario Lemina, Roland Sallai, Yunus Akgün, and Mauro Icardi sef no dey di squad because of small injury or special training. U sabi say, Osimhen  score one goal and give one assist for same Alanyaspor game last weekend. Say im go return […]

todayMarch 3, 2026 42

Sports

Temitope Adeshina Make History, Win Third Big 12 Indoor High Jump Title

Texas Tech high jumper, Temitope Adeshina, don win her third Big 12 indoor high jump title straight. According to report, She jump 1.96m wey be di second-best for her school history. Dis jump still break di old meet record wey Akela Jones and Destinee Hooker set. Temitope na di first woman for Big 12 to win three indoor high jump titles back-to-back since Rylee Anderson between 2021-2023.

todayMarch 2, 2026 39

Sports

Nigerian Athletes Scarra US NCAA

Say Nigerian student-athletes don scatter ground for US over di weekend, carry 32 medals for 2026 NCAA indoor conference championships. For SEC side, 19-year-old Samuel Ogazi from Alabama run 44.72s for men 400m, break African and Nigerian record as e carry gold. LSU athlete Ella Onojuvwevwo  shine wetin nor good, win women 400m with personal best 50.96s to become one of di fastest African women ever for indoor race. Kayinsola […]

todayMarch 2, 2026 31

Sports

Remo Stars Break Seven-Game Curse, Hammer Katsina United 2-0

Remo Stars don finally break dia seven-game winless run, beating Katsina United 2-0 for Ikenne on Sunday. Haruna Hadi na di main guy, wey score di  two goals afta di first half end 0-0. Coach Usman Abdallah, wey just take over last Thursday, enjoy im first big win with di team. Before now, Remo Stars never win since dem knack Ikorodu City 1-0 for January 14.

todayMarch 2, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds