Colombia right-wing Presido, Abelardo de la Espriella, don order immigration crackdown, as e tell authorities make dem start to dey arrest foreign pipo wey enter di country without proper papers, and wey don commit crime, so dem fit deport dem.
Abelardo wey enter office on August 7, after e campaign say e go deal with crime and drug-trafficking gangs.
Immigration no be major part of im campaign, but for security meeting wey e hold for Barranquilla on Sunday, e talk say, he no go allow illegal migrants, no matter where dem come from.
E say gornment go start deportation process dis week based on im presidential order.