By: Mariam Ajayi
Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo.
Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Naija dey prepare for Friday’s big game.
E say di team don put di result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on Madagascar.
Chelle say dem don complete dia final training and prepare well, adding say managing pressure na part of dia job as di qualifiers dey start.