United States President, Donald Trump, don repeat im claim say Christians for Nigeria dey face mass killing, as e warn say di wahala don reach level wey fit wipe Christianity comot for di country. For video wey White House drop for X (Twitter) on Wednesday, Trump talk say “thousands and thousands of Christians” don die for di hand of “radical Islamists,” wey e call “mass slaughter.” E come yarn say e don classify Nigeria as ‘country of particular concern’, one legal status wey mean say America go dey watch di matter closely. Trump talk say di figures of di killings don reach 3,100 Christians for Nigeria out of 4,476 globally, as e call on Congress make dem act “immediately” to stop di wahala.
Trump come add say di United States no go fold hand dey look while Christians dey die for Nigeria and oda countries. According to am, America “ready, willing and able” to protect Christians worldwide, warning say di killings “no go happen again.” E even threaten before say e fit deploy US Department of War to Nigeria if di “Christian genocide” no stop. Meanwhile, President Bola Tinubu don reply say Nigeria still dey run constitutional democracy wey dey protect religious freedom, and di claim of religious intolerance “no reflect di true reality of Nigeria.” Tinubu insist say since 2023, di government don dey engage Christian and Muslim leaders to find solution to di insecurity wey dey affect all Nigerians “across faiths and regions.”