Senior woman chief justice of Nigeria, Kudirat Kekere-Ekun don warn say dis “cash-and-carry” way wey some lawyers dey carry practice law now dey spoil di image of di profession and fit damage justice system for Nigeria.
She yarn dis one for 2026 NBA Legal Practice conference, say make lawyers wake up and return to correct ethical behavior wey go protect clients and di law.
Kudirat still use di opportunate tuk say even though lawyers deserve beta pay, dem nor suppose put money first pass justice, responsibility, and truth.