By: Esther Ayoola
Justice Mohammed Garba Umar of Federal High Court for Abuja don fix January 22, 2026, to start trial of di AAC presidential candidate for 2023 election, Omoyele Sowore, say im allegedly do criminal defamation of President Bola Ahmed Tinubu.
Department of State Services, DSS don earlier file five-count charge for September 2025 against Sowore, plus X Corp and Meta, say dem allow post wey call Tinubu “criminal.”
But on Monday, afta request from Sowore lawyer, Marshall Abubakar, to DSS counsel Akinlolu Kehinde, SAN, di judge strike out di names of di two foreign companies from di case.
For Oga Marshall wey be sowore lawyer, say di gorment sef nor ready for di case.