Omoyele Sowore

11 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Sowore Vow Commot First Lady For Office If E Win 2027 Election

By: Mariam Ajayi African Action Congress presidential candidate Omoyele Sowore don drop am say if hin win di  2027 presidential election, say hin go cancel di office of di first lady, dis one nor be sherekanbia. Sowore drop dis hot statement TV sit down tok  on Thursday, say im nor dey for dat one wey im wife go con sit dwon for front of motor, begin do like small nokia […]

todaySeptember 18, 2026 2

OBODO NAIJA

Sowore Vow Say E Go Make Nigeria Four Refineries Work If E Win 2027

By: Mariam Ajayi African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don promise say e go make Nigeria four government-owned refineries work if e win di 2027 presidential election. Sowore make di promise on Tuesday during interview for one media station, where e blame corruption and mismanagement of public funds by past administrations for di refineries’ failure. E say if Nigeria fit refine crude oil locally, di country go save […]

todayAugust 26, 2026 11

OBODO NAIJA

Lawyers Argue For Court On Monday To Stop Sowore Trial

By: Yusuf Abuh Two Senior Advocates fight with words inside court on Monday to stop Omoyele Sowore trial over document delay. Lawyer Adeyinka Olumide-Fusika ask Judge Umar inside court on Monday to shift di case because court registrar just release paper. Di lawyer fight for shift inside court on Monday because court delay di paper from July 26 to August 3. Sowore legal team ask for time inside court on […]

todayAugust 3, 2026 15

OBODO NAIJA

Makinde No Get Weight for 2027 Race – Bwala

By: Esther Daniel Daniel Bwala, Special Adviser to oga  Bola Tinubu on Policy Communication, don tok say Oyo State Govor Seyi Makinde and AAC presidential candidate Omoyele Sowore no get strong political weight ahead of 2027 election. For TV siddon tuk, Bwala tok say all di political calculations no dey favour Makinde, sti add say di Oyo State govo no fit even win presidential election for im own state. Bwala […]

todayJuly 20, 2026 14

OBODO NAIJA

Sowore Create New Mobile App For 2027 Election

By: Yusuf Abuh Di African Action Congress (AAC) presidential candidate, Omoyele Sowore, don officially launch one ogbonge mobile application wey dem call "SoworeNow" to gather support. Sowore announce dis technology movement on Thursday, July 16, 2026, through one video post wey he share on top im official Instagram page. With dis new application, supporters across di country fit easily get true update on top di campaign, connect with other members, […]

todayJuly 17, 2026 19

OBODO NAIJA

Sowore Fight To Get Im Freedom Back

By; Emmanuel Ariyo-David Federal High Court for Abuja don shift ruling till June 30, 2026, say na dia, dem go hear di bail application of senior man activist and publisher Omoyele Sowore Justice Mohammed Umar take di decision after both sides adopt dia processes for di mata. On June 16, di court revoke Sowore bail and order make dem arrest am after e no show for court over allegations of […]

todayJune 24, 2026 23

Politics

After Arrest Warrant, Sowore Show Face for Abuja Court

By : Jolayemi Olajide African Action Congress (AAC) presidential candidate, wey be senior man activist, Omoyele Sowore don appear for Federal High Court for Abuja on Monday after court issue bench warrant for im arrest. Sowore enter the court with members of im group wey carry placards to show support for am. Justice Mohammed Umar bin cancel im bail on June 16 after he no show up for previous hearing, […]

todayJune 22, 2026 16

Politics

Court order police to arrest Omoyele Sowore

By  : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order say dem must arrest AAC presidential candidate, Omoyele Sowore, sake of say im nor show face for im trial. Dem suppose start the case wia DSS charge Sowore for cybercrime, dem say e call Presido, Bola Tinubu, "criminal" for social media. Sowore bin don tell court say na im go defend imself since im lawyers don comot body for […]

todayJune 16, 2026 15

National

Sowore question Tinubu Nomination Form for 2027 general elections

By: Esther Ayoola Senior man human rights activist and former presidential candidate Omoyele Sowore don cut chain again dey drag wi oga presido, Bola Tinubu, say why im go persin go pick nomination form am. Di reaction come afta former Ebonyi State govo and Minister of Works, David Umahi, sign Tinubu presidential nomination form wey cost N100 million. Umahi, for statement through him aide Francis Nwaze, say di endorsement na […]

todayMay 5, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds