OBODO NAIJA

Court sentence four Owo church attackers to death, release one person 

todayJune 3, 2026 4

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Federal High Court for Abuja don sentence four guys to death by hanging because of the deadly attack wey dem do for Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State.

Justice Emeka Nwite convict di four bad boys on Wednesday after the judge see say di evidence wey DSS bring clear wetin nor good, say dem be part of di  terrorist group wey commit the crime.

Di convicts, Idris Abdulmalik Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, and Abdulhaleem Idris, stand trial for inside court based on how dem kpai over 40 church members and wound plenty others on June 5, 2022.

Inside di five people wey dem change for the case, di judge release and clear one man wey im name na Momoh Otuho Abubakar say im hand no dey the matter.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds