OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

todayMay 26, 2026 4

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election.

The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress.

As if dat one no do, the court still talk say the person must pay another N1 million change give the Attorney-General of the Federation.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds