FEDERAL HIGH COURT

7 Results / Page 1 of 1

Background

crime

EFCC Don Withdraw Cybercrime Case Against BUK Student

By: Kofoworola Olayinka Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don withdraw di cybercrime charge against final-year Bayero University student, Maryam Shehu, and another Nigerian, Abubakar Abdulhamad. Di two of dem face separate case for Federal High Court for Abuja on Thursday over alleged cybercrime and spreading bad information about EFCC. EFCC accuse Maryam of making social media post wey allege say some EFCC pipu beat one man and collect N20 […]

todayAugust 21, 2026 12

Lagos

Court Jail Three Suspects Say Dem Import Gun 

Senior Man judge for Federal High Court inside  Lagos don cut pipo joy short, order make three suspects wey Customs gbab over alleged unlawful importation of pump-action rifles remain for Correctional Centre for 15 days. Na Justice Friday Ogazi give di order on Wednesday against Kenneth Mbonu, Kenneth Agwu and Choima Onuoha, pending di completion of investigation into di case. Di suspects go remain for custody until September 1, 2026, […]

todayAugust 20, 2026 9

National

INEC Clear Ground Begin Share Election Materials For Osun Saturday Election  

By: Kofoworola Olayinka Osun state, don dey ready body to vote say INEC don start to distribute sensitive election materials to all di 30 local government areas for Osun on Thursday night ahead of Saturday gorfnorship election. Di distribution happen under di supervision of Osun Resident Electoral Commissioner, Oluwatoyin Babalola. Di process bin delay earlier after Federal High Court order INEC to include di Social Democratic Party for di ballot.

todayAugust 14, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal High Court Sentence Three Kidnap Suspects To Life Imprisonment Inside Abuja

By : Jolayemi Olajide Justice Salim Ibrahim inside Abuja Federal High Court sentence three suspects on Thursday to life imprisonment for dia link to di abduction of pupils and teachers for Oyo State Oriire Local Government Area, as di judge order make di sentence start count from di date dem arrest dem. Di defense lawyer beg di court for leniency before di sentencing, happening because di convicts plead guilty and […]

todayJuly 23, 2026 12

OBODO NAIJA

Court Order Make Police Arrest Self-Claimed PFIPC Oga Adeyemi

By : Jolayemi Olajide Justice Muhammed Umar of Federal High Court for Abuja don order make police arrest Adeniyi Adeyemi after e no show for court to answer the charges against am. Adeyemi, wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, suppose take plea for eight-count charge wey involve forgery, fraud and impersonation. Even though one lawyer, Genesis Francis, appear for am, the defendant no come court […]

todayJuly 14, 2026 10

OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election. The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress. As if dat one no […]

todayMay 26, 2026 18

OBODO NAIJA

How Abuja Court Carry $13 Million From Lagos Socialite Aisha Give Federal Gorment

Federal High Court for Abuja don send order say di $13 million wey dey linked to Lagos socialite, Aisha Achimugu, and her company, Oceangate Engineering Oil & Gas Ltd,  say right now, don give   Federal Gornment di money. Justice Emeka Nwite give di judgement on Wednesday say  di EFCC don prove beyond doubt say di money di madam kpake am fraudulently. Di Court  say, di company no fit explain where […]

todayMarch 25, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds