Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
NCDC don tuk say make pipo nor panic afta dem confirm new COVID-19 case for Cross River State, say no sign of widespread spread for now.
According to NCDC DG, Dr Jide Idris, dem say all di persons wey come in contact with di patient dey under monitoring and dem dey track dem properly.
Cross River State Health Commissioner, Dr Henry Ayuk, explain say di case na Chinese man wey work for Akamkpa LGA and wey bin come Naija for work on March 17, naim show di symptoms.
Health authorities say dem don dey manage di situation to prevent any further spread and protect public health for di state.
Written by: News Author
coronavirus update Nigeria COVID-19 COVID-19 cases Nigeria Cross River State disease control Nigeria NCDC Nigeria health news public health nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026