By : Jolayemi Olajide
Nigeria Customs Service don warn say di recruitment update wey dey spread for social media na fake and no come from di agency.
Customs spokesman Abdullahi Maiwada tok for X on Thursday, advise Nigerians make dem ignore di false information.
E say Customs go only announce recruitment through dia official communication channels and verified social media pages.
Maiwada also beg members of di public make dem check information well before sharing am to avoid spreading fake news.