By: Rilwan Agbomeji
E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian.
Di latest reduction sharply drop (gboza for ground), afta Chairmo, Aliko Dangote do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on friday, and dat, di reduction go continue go tey better style.
Konfam collobi update from refinery official say, dis commando move na part of effort to make fuel cheap and compete with di once wey dey come form obodo oyinbo.