OBODO NAIJA

Defence Minister Say FG Serious About Safer Nigeria

todayAugust 31, 2026 4

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Defence Minister Gen. Christopher Musa on Sunday, August 30, 2026, don promise Nigerians for obodoyinbo say Federal Government dey serious about making Nigeria safer and secure for everybody.

Musa yarn dis wan for meeting with Nigerians wey dey  live for Angola, on di sidelines of African Union meeting for Luanda.

E say gornment dey increase soldiers and improve dia equipment and ability to fight security threats across di country.

Musa yarn some security problems dey linked to instability for Sahel region wey dey spread enter Niger.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds