Nigeria security

15 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Defence Minister Say FG Serious About Safer Nigeria

By: Kofoworola Olayinka Defence Minister Gen. Christopher Musa on Sunday, August 30, 2026, don promise Nigerians for obodoyinbo say Federal Government dey serious about making Nigeria safer and secure for everybody. Musa yarn dis wan for meeting with Nigerians wey dey  live for Angola, on di sidelines of African Union meeting for Luanda. E say gornment dey increase soldiers and improve dia equipment and ability to fight security threats across […]

todayAugust 31, 2026 8

Local

Police Trace Death Threat to Prison Inmate

By Oluwatosin Ibrahim Police investigation reveal say death threat message wey Benin City resident, Odion Akagbosu, receive recently come from one inmate inside Oko Correctional Centre instead of kidnappers outside prison, exposing alleged criminal activities from inside correctional facilities. Investigators say inmates for correctional centres like Kirikiri in Lagos, Kuje in Abuja and Warri in Delta allegedly dey coordinate internet fraud, extortion, fake bank alerts, robbery and kidnapping while still […]

todayAugust 7, 2026 11

Local

Troops Kill Nine Terrorists, Arrest Six Suspects

By Oluwatosin Ibrahim Nigerian troops on Friday announce say dem kill nine terrorists during precision airstrike for Mai Hisari Arege, Abadam Local Government Area of Borno State, after military aircraft track three motorcycles carrying di suspects. Military authorities also confirm say troops of Operation SAFE HAVEN arrest six suspected kidnappers and terrorist logistics suppliers for hospital in Jos South, Plateau State, where dem dey receive treatment for gunshot injuries. Di […]

todayAugust 7, 2026 8

OBODO NAIJA

Senate Say State Police Bill Work No Go Stop

By: Esther Daniel Di Senate don assure Nigerians say work on State Police Bill no go stop despite National Assembly recess. Senate spokesman Yemi Adaramodu tok say committees still dey work to harmonise di bill with House of Representatives. According to am, di recess no go delay di constitutional amendment process. Di bill don get support from gofnors, state assemblies and oda stakeholders wey want better security.  

todayAugust 5, 2026 9

OBODO NAIJA

Obi Ginger Oga Presido Tinubu To Dey One Side For Beta Leader To Rule Naija

By: Esther Daniel Labour Party presidential candidate for 2023 election, Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu again, say make wi presido step aside dat im nor get di doings to solve naija security wahala. Obi yarn dis one for tv sitdown tuk on sunday, dat baba need rest oh. E still tok say no mata how many governors support Tinubu for 2027 election, na hungry and suffering Nigerians go […]

todayJuly 27, 2026 11

OBODO NAIJA

“Enough of Condolence Visits!” 2027 Presidency Hopeful Tell Tinubu To Fix Security Now

By : Jolayemi Olajide 2027 presidential hopeful for YPP, Peter Agada, on Thursday urge President Bola Tinubu to quickly change Nigeria security system and stop di rising attacks across di country. Agada make di call for Abuja while reacting to di July 12 attack on Akpachi and Otukpo-Nobi communities for Benue State, where gunmen kill and attack residents. E accuse Federal Government of always visiting victims and making promises after […]

todayJuly 16, 2026 12

south west

Senate explain to Makinde why im need to dey careful with security mata

By : Jolayemi Olajide Senate don warn Oyo State Govo, Seyi Makinde, say make e no dey make statement wey fit spoil Federal Gornment and security agencies effort to fight terrorism and kidnapping, after e call on United Nations make dem investigate the abduction of school children and teachers for Oriire Local Government Area. Senate give di warning after dem discuss motion wey Senate Leader Opeyemi Bamidele bring about di […]

todayJuly 14, 2026 12

National

Reps Drop Dia State Police Bill, Follow Presidency Own

By : Jolayemi Olajide House of Representatives don suspend work on dia own constitutional amendment bill for state police and decide to continue with similar bill wey Presidency submit. During Tuesday plenary, lawmakers introduce the Executive-sponsored Constitution Alteration Bill and quickly pass am through first and second reading. After debate, the House send the bill go Committee on Constitutional Review make dem examine all the provisions, safeguards and how the […]

todayJuly 14, 2026 14

OBODO NAIJA

 Ndume Tell Tinubu Make E Come Out Face Nigerians On Top Dis Hard Time!

By : Jolayemi Olajide Senator Ali Ndume don tell President Bola Tinubu make e stop dey use aides talk and make e carry im body come out talk to Nigerians direct on top di many many economic and security wahala. Ndume yarn dis one inside Aso Rock on Friday July 10 2026 after im hold meeting with di Presido. He explain say Nigerians need to hear from di leader direct […]

todayJuly 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds