Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Delta State Government don condemn report wey talk say some women suffer harassment and sexual assault during Ozoro Festival, dem say di act na barbaric and no acceptable at all.
Commissioner for Works (Rural Roads) and Public Information, Charles Aniagwu, don call on security agencies make dem quickly investigate di matter and arrest those wey dey involved.
E still assure residents say government go continue to protect di rights and safety of everybody, especially women and other vulnerable people.
Aniagwu come advise community leaders and festival organisers make dem put beta security measures for ground to stop dis kind thing from happening again.
Written by: Ridwan Agbomeji
Delta Ozoro festival crisis Delta State festival probe Ozoro festival wahala
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026