Wi Oga Presido Bola Tinubu don describe imself as “die-hard democrat” as e urge Nigerian politicians make dem respect democratic values and obey rule of law no matter di cost.
Tinubu talk dis one on Wednesday for interfaith breakfast wey happen for State House with executives of All Progressives Congress (APC), members of di National Working Committee and Inter-Party Advisory Council (IPAC).
According to di president, im and some other politicians don suffer plenty while fighting for democracy, including detention, protest and exile during di struggle years.
Tinubu add say na through dat struggle dem take form National Democratic Coalition (NADECO) and continue to defend democracy for Nigeria for over 26 years.