Sports

DR Congo Fans Scatter Stadium After Dem Chop Beating from Senegal

todaySeptember 11, 2025 8

Background
share close

Football fans for DR Congo lose control Tuesday evening as dem run mad and scatter parts of Stade des Martyrs for Kinshasa after their team chop 3-2 loss from Senegal for 2026 World Cup qualifier. Di 80,000-capacity stadium full to the brim as di Leopards dey chase one historic win wey for push dem closer to qualify for next year World Cup, but as hope scatter, everywhere burst. Hope bin high for DR Congo fans as their team start the World Cup campaign with fire, but wahala land as dem still lose for home, even after coming back twice from behind. As final whistle blow, anger just explode, Some fans vex tear seats, break plastic fittings, and begin throw dirty and debris enter pitch like say na war zone. Security try hold ground but the crowd mad pass them, dem rush escort players and match officials enter tunnel sharp-sharp before gbege go turn full-blown riot. Local media yan say at least dozen rows of seats gats scatter, plus advertising boards and some pitch-side gear dem destroy join. No life lost, but some fans suffer small small injury for the gbege, and police carry some people go station as dem make arrests.

The Congolese Football Federation (FECOFA) don condemn the madness, say dem go work hand-in-hand with security to catch those wey cause the gbege. Dem talk for one statement on Wednesday: “We sabi say fans dey disappointed, but dis kain yawa no be wetin go help us. E dey spoil our image and fit make future matches suffer.” Police don seal off the damaged parts of the stadium as dem dey check how bad the damage be and wetin go need repair. This gbege don make people dey worry if Stade des Martyrs go fit host DR Congo next home qualifier later this year. Coach Sébastien Desabre yan after the match say make fans no lose hope, say dem still dey fight. “We still dey the race,” he talk. “The boys put body for ground, and we go continue work hard to chase our World Cup dream.” DR Congo dey third for their group after the loss, and important matches against Togo and Sudan still dey front.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app