By: Mariam Ajayi
Gaza City don turn scene of panic after drone strike knack one police post, kpai about six pipo, and wunjure several others.
Di attack happen for busy hours for central city, close to di municipality and one park wey childrensis and other residents dey gather.
Local paramedics say di casualty figure fit rise as emergency workers dey rush victims wey wunjure for treatment.
Earlier, another attack knack one motorcycle for Nuseirat refugee camp, kpai one pesin, kon add to di growing number of badness for inside di obodo Gaza.