Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Say one Early mor mor fire don destroy one-storey shopping complex, wey dey Ajegunle Boundary, Lagos, wia business pipo dey sell clothes.
No life loss for di fire except for for plenty money, di Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA ni dey konfamate dis tori.
LASEMA Permanent Secretary, Olufemi Oke-Osanyintolu, explain say dem receive distress call around 2:40 a.m. and reach di scene by 3:22 a.m., but di building don already burn well, well before dem reach dia.
Oke-Osanyintolu add say di fire spread quick because of di cloth, and from dia first check, say na electricity cause di fire.
Written by: News Author
Ajegunle clothes market Ajegunle fire Fire outbreak Lagos LAGOS MARKET FIRE
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025