Lagos

Early Mormor Fire Scarra 48 Shops For Elegushi Market, Lekki

todayDecember 15, 2025 5

Background
share close

By: Esther Ayoola

One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops.

Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday.

E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, fire don already fence the market.

According to Oke, emergency response team sha control the fire, so e no spread enter other areas wey e suppose to damage.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app