By: Esther Ayoola
Newcastle United manager Eddie Howe don make am clear say Man united job nor dey im eyes, because e dey very happy for him job.
Howe don dey manage Newcastle since November 2021, and na one of di longest-serving managers for Premier League now.
Even though some top pipo like di sporting director and chief executive don change, Howe don build strong relationship with di new bosses.
Newcastle dey ninth for Premier League, dem dey near top five, plus dem reach last-16 for Champions League and semis for Carabao Cup.