By: Rilwan Agbomeji
Egypt don wunjor Naija Golden Arrows, showing dia strong doings for handball, say dem beat Nigeria 48–22 for BK Arena, Kigali on Tuesday.
Di win mean say, Naija nor go play semi-final and nor qualify for di 2027 handball World Championship.
Egypt control di game from start, dem lead 24–10 by half-time before dem continue crushing Nigeria for second half.
Egypt shooting sharp wella, na so di thing dey do kpologor for Nigeria post, dem make 76% of dia shots, while Nigeria only manage 43%, and Egypt sabi score from distance pass Nigeria.