Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Sports
todayNovember 28, 2025 9
Super Eagles duo Ola Aina and Taiwo Awoniyi no go show face as Nottingham Forest battle Brighton on Sunday for Premier League. Awoniyi still dey struggle with knee injury wey make am miss Forest clash with Liverpool last weekend, even after e just return to full training from serious abdominal injury earlier dis year. For Aina matter, manager Sean Dyche don still cast doubt on di defender return, even though e don dey train again. Aina bin knack hamstring injury for Nigeria 1-1 draw with South Africa for September World Cup qualifiers and since then, di 29-year-old ex-Chelsea man don miss four Super Eagles matches and fourteen games for club level.
Meanwhile, Nottingham Forest dey enter dis game with ginger after dem flog Liverpool and Leeds, show say dem don dey find rhythm for home ground where dem draw Manchester United and beat Leeds. Brighton own form na mix, dem fit grind out draws like di Crystal Palace one, and still get firepower for home, but dia away form no too stable even though dem dey score steady. Forest lineup na: Sels, Savona, Milenković, Murillo, Williams, Sangaré, Anderson, Ndoye, Gibbs-White, Domínguez, Jesus. Brighton lineup include: Verbruggen, Wieffer, Hecke, Boscagli, Kadıoğlu, Baleba, Ayari, Minteh, Rutter, Gómez, Welbeck.
Written by: News Editor 1
Awoniyi injury Forest vs Brighton Nottingham Forest news Ola Aina injury
todayDecember 12, 2025 12
todayDecember 12, 2025 3