Sports

Esther Okoronkwo Bounce Back From Wunjury

todayJune 30, 2026 14

Background
share close

Small moral don enter Super Falcons camp as  midfielder Esther Okoronkwo return to action for AFC Toronto, playing 25 minutes as dem beat Vancouver Rise 3-1 on Sunday.

Di 29-year-old bin stay out for almost two months because of wunjury  wey she suffer during one league match against Halifax.

Her comeback don give Nigeria better hope as di Super Falcons dey prepare for 2026 Women’s Africa Cup of Nations wey go hold for Morocco from July 25 to August 16.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds