National

FG Add Fresh Charges for El-Rufai Case, Say Im Tamper with National Infrastructure

todayApril 24, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Federal Gornment, through Department of State Services and dia lawyer Oluwole Aladedoye, on Thursday for Federal High Court Abuja,  don add new charges against former Kaduna governor Nasir El-Rufai.

Say im interfere with critical national infrastructure and access classified information without approval.

Dem file di korectted version of five-count charge on April 13, 2026, to replace di earlier three-count charge wey dem first bring come on February 16, 2026, to take strengthen dia case against di man.

For court on Thursday before Justice Joyce Abdulmalik, El-Rufai plead not guilty to all di charges when dem read am give am.

Prosecution  tell court say di new charge get beta details and evidence, so dem beg make court accept am for di case  moving forward.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app