Federal Gornment don approve make dem break down and rebuild Carter Bridge for Lagos, and di whole work go cost about N548.98 billion.
According to report, after investigation, dem find out say di part wey dey inside water don spoil beyond repair.
Minister of Works, Dave Umahi, na im announce di approval after Federal Executive Council meeting wey hapun on Thursday.