By: Esther Ayoola
Federal Gornment don start plan to evacuate Nigerians wey dey South Africa, based on xenophobic tension and protest.
According to Foreign Affairs Minister Bianca Odumegwu-Ojukwu, wey tuk dis mata on Sunday for her X page, baba Seyi don give order for Nigerians Safety first.
Say na about 130 Nigerians don already register for voluntary repatriation flights.
Dis evacuation dey happen because of rising protest wey pipo dey accuse foreigners for unemployment and insecurity, and na through planned flights dem go carry affected citizens come back Naija.