By: Esther Ayoola
Federal Gornment don declare Friday, May 1, 2026, as public holiday to mark International Workers’ Day.
Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce di holiday and hail Nigerian workers for dia hard work and contribution to di country.
E tuk say workers effort dey very important for Naija growth and better development.
Gornment sti encourage dem make dem continue to dey patriotic, work well, and stay committed to dia duties.