Obodo Niger

FG Declare Two Days Public Holiday For Eid-Ul-Adha Celebration

todayMay 26, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Federal Gornment don declare Wednesday, May 27, and Thursday, May 28, 2026, as public holiday to take celebrate dis year Eid-ul-Adha.

Di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, na am make di announcement through one statement wey di Permanent Secretary of di ministry, Magdalene Ajani, release on Monday.

Di government tuk say dis holiday show say dem respect di Islamic faith wella wella.

Di minister come congratulate all Muslims and e beg Nigerians make dem use dis festive period pray for peace, security, and beta progress for di country.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds