Lagos

Fire Scarra Property Worth Millions for Apapa Customs Office

todaySeptember 29, 2026 5

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Fire don scarra di Nigeria Customs Service Western Marine Command office for Apapa, Lagos, and destroy property worth millions of naira on Monday morning.

Di fire wey start around 10:23 am, say na NEPA light burn enter di  conference room, con quick spread to other parts of di building before Lagos State fire service come help quench di fire.

Di new Deputy Comptroller of Customs, Timothy Jonah, wey just resume duty describe di matter as unfortunate and yarn say committee go investigate wetin cause di fire.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds