Sports

Flying Eagles Don Fly Go Chile, Ready To Shake Ground For U-20 World Cup

todaySeptember 12, 2025 6

Background
share close

Naija U-20 ballers, Flying Eagles, go waka go Chile this Sunday as dem intensify levels for 2025 FIFA U-20 World Cup. Di squad wey still dey camp for Abuja now go use Chile hold two-week training base to set demself well before dem first Group D match wey go happen against Norway on Monday, September 29. Dem no dey alone for di group, Saudi Arabia and Colombia sef dey wait for corner, but Flying Eagles dey ginger to show say Naija no come play. Head coach Aliyu Zubairu go drop him final 21-man squad on Friday, September 19. Officials don confirm say some Europe-based players wey make the final list go link up with the squad as dem dey move go South America.

Naija Flying Eagles dey come back strong for 2025 U-20 World Cup, after dem knack quarterfinals for 2023 edition wey hold for Argentina. With better mix of local pikin and abroad-based pros, dem dey hope to go deeper this time, carry home bigger trophy. Seven-time African champions go start waka against Norway, then face Saudi Arabia and Colombia for group play.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app